Police: Paaarrk! Wey ur particulars?
Me: Here they are.
Police: They are incomplete.
Me: Check them well, they are complete
Police: Do you want to teach me my work? By the way where
you dey come from by this time of the night?
Me: I go burial
Police: Who die?
Me: Na one Policeman
Police: Wetin kill am?
Me: He collect juju money from one driver for check point
and him hand come swell he come die.
Police: Na your friend?
Me: No
Police: Your relation?
Me: No
Police: Wetin you come go do for the burial?
Me: I go remove the money from the dead man hand.
Police: Wetin concern you for the matter
Me: Na me be the native doctor wey do the juju
(The policeman was staring at me now)
Me: Oga police, I beg I don tire, make I find you something
make u let me dey go.
Police: Police is your friend, we no dey collect bribe
again.
Me: Thank you sir... but I just want to appreciate you.
Police Oga abeg go na, I no want... shuoo, infact I no be
police i be vigilantee
Una Happy Weekend oooh.
0 Comments